By: Esther Ayoola
Over di weekend, nor be small flex for wi oga Presido, Bola Tinubu, Imo State Governor Senator Hope Uzodimma and other big people joinbodi with Lagos State Governor Babajide Sanwo-Olu flex, say dem dey celebrate di 73rd Eyo Festival for Lagos on Saturday.
Di festival wey people dey call Adamu Orisa play, shelle for Tafawa Balewa Square, if you see di agbada wey wi oga presido dek, you go clap.
On behalf of di presido, governor Sanwo Olu nor hide mouth talk about di festival, say, di Eyo Festival no be just ordinary celebration, but one strong sign of Nigeria rich culture and tradition.