By: Blessing Aminu
Presido Bola Tinubu don call traditional rulers, religious leaders, youths, women and communities for North-Central make dem join body wit gorment and security agencies fight insecurity.
Tinubu tok dis for 2026 North-Central Security Summit for Makurdi, Benue State.
Di Presido, wey SGF George Akume represent, tell traditional and religious oga make dem dey alert security agencies anytime dem notice danger.
E also beg Nigerians make dem share information wit security agencies and no hide criminals because of family or friendship.
Tinubu say everybody must join body make peace dey North-Central, because insecurity no dey know state boundary.