By: Kofoworola Olayinka
Ehwooo, make God shout for satan, na so devil one bin take di life of One 55-year-old driver, but hin escape with serious wunjure after train jam im Honda car for PWD railway crossing for Lagos.
according by lagos traffic oga, Olalekan Bakare-Oki, Di train bin dey go Agege when di askident happen, and di car spoil wetin nor good.
Beofr LASTMA officials and security men rescue di driver and comot di car from di railway track, but traffic still bokku for di area right now Police dey touchlight di mata