By : Jolayemi Olajide
US Presido, Donald Trump don drop micro soft word oh, say im tire Israel Prime Minister, Benjamin Netanyahu, beta warning for phone call.
Trump yarn dis one for interview on Wednesday say di way netanyaho dey manhandle Beirut, Lebanon, e nor make brian at all.
Reports from Axios and ABC News talk say Trump dey fear say if Israel go bomb Beirut, e go scatter the peace talk wey dem dey do with Iran to end the Middle East war.
But even with all the hot exchange, Trump still clear air say im and Netanyahu na tight guys and dem still get very good relationship.