By: Rilwan Agbomeji
President of Dangote Refinery, Alhaji Aliko Dangote, don calm di internet, talk say US President Donald Trump no get any wahala at allwith di $20 billion Dangote Refinery.
E yarn dis while e dey react to social media gist wey scatter everywhere, wey some people begin talk say Trump no happy say Africa biggest refinery dey Nigeria.
Di talk burst afta Trump threaten say im go hit terrorists wey dey attack Christians for some parts of Nigeria, and people begin wrongly join am with refinery marras.
Dangote clear am say di threat na security issue, no be business or refinery palava, and e beg Nigerians make dem focus truth and no carry fake news waka.