By: Esther Ayoola
US Presido, Donald Trump say like dis now, e go delay attack for Iran energy plant, by 10 days, reach April 6, and dat, di peace tuk dey go well.
However, ogas for Iran dey yan newspipo say, US peace plan, dey one-sideded and e nor fair.
Pakistan Foreign Minister Ishaq Dar say dem tanda for centre dey tuk to U.S. and Iran, to try stop di war, and Turkiye plus Egypt dey help too.
According to Iran Deputy Health Minister Ali Jafarian, say at least 1,937 pipo don kpai for four weeks old war.