Listeners:
Top listeners:
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Plenty motorists nearly kpai yesterday as one tipper truck wey dey speed jam one broken-down oil tanker and other big trucks for Berger Bridge, inward Epe, along Epe/Ibeju Lekki Road for Lagos. As people begin raise alarm, operatives from Lagos State Emergency Management Agency (LASEMA) rush reach di scene. When dem land, dem discover say one oil tanker with plate number MKA-232ZE, wey dey carry Liquefied Petroleum Gas (LPG), don break down earlier because e engine spoil, and e dey block small part of di road.
As mechanic dey try fix di tanker, one tipper wey carry granite stones lose control and sharply jam di parked tanker and another big truck wey dey carry tyres. Up till press time, dem never still get di plate numbers of di two other trucks wey follow jam. First investigation show say na di tipper driver overspeed cause di crash. Nobody die but di tipper driver and him conductor chop serious injury. Officials from Lagos State Ambulance Service give dem first aid before dem carry dem go Epe General Hospital for more treatment.
Written by: News Editor 2
Lagos Road Accident Tipper Truck Crash Lagos
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025