By Ebi Oboko
US say dem don dey control Venezuela oil sales and dat, na dem go decide how Venezuela go take spend dia money.
US Department of Energy na dey troway dis one for social media, say dem don even start to sell the oil for world market, and all the money go first enter bank accounts wey US dey control.
Dem say, dem don succeed sell about 30 to 50 million barrels, and the sales go continue as US government see fit.
Later, Trump tuk say, Venezuela na younger broda, say dem use di oil money buy only American-made goods like food, medicine, and equipment to fix light and energy for Venezuela.