obodo oyinbo

US-Iran Make Big Progress For Nuclear Tuk

todayFebruary 27, 2026 3

Background
share close

By: Esther Ayoola

Omani foreign minister Badr Albusaidi, say US and Iranian officials don make “big progress” for nuclear tuks for Geneva dis week.

Badr clear tori pipo on Thursday afta di meeting for Geneva, say dem plan to continue tuks  sha  afta dem go back dia countries, and technical-level discussion go hapun for Vienna next week.

Iran foreign minister Abbas Araghchi sef clear mata say dem agree for some tins but some, no agreement.

Say Dis fit hellep, US Presido, Donald Trump comot mind from attacking Iran.

Written by: News Author

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app