obodo oyinbo

US Police Arrest Driver Wey kpai Nigerian Graduate Fadero

todayMarch 25, 2026 3

Background
share close

Metropolitan Nashville Police for US don arrest one driver wey dey link to fatal hit-and-run wey kpai one Nigerian graduate, Oluwalayomi Fadero.

Report from local station WSMV4 say di mata na since on Friday after di suspect, Ray Eugene Padgett, thief one vehicle come dey run.

Di owner of di truck trace am reach one area, but when di suspect notice say dem dey follow am, e reverse motor jam another car for back.

Police later use helicopter track am, but as e try escape, e still jam one undercover police motor, come make dem start serious high-speed chase before dem arrest am.

Written by: Ridwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app