CRIME NEWS

6 Results / Page 1 of 1

Background

obodo oyinbo

Court don find two men guilty for fire attack on Keir Starmer property.

By : Jolayemi Olajide London court don kpake  two  jaguda boys, Roman Lavrynovych and Stanislav Carpiuc, find  dem guilty, say dem bin dey plan to  burn prime minister,  Keir Starmer. house and car. Di two men, wey be 22 and 27 years old, do di attack for May 2025. Dem go target two houses for north London one house wey company wey Starmer use to direct manage, and di second […]

todayJune 15, 2026 7

Lagos

Lagos Police Gbag Iron Damage Man Say Im Fake Im Own Kidnap

Lagos State Police Command say dem gbab one scrap iron dealer, and im friends, say wey dem chout iron damage, iron damage na pipo dem dey kidnap, dey damage pipo peace. Lagos Police Commissioner,  Fatai Tijani,  naim dey break dis news on Tuesday give journalists for dia headquarters for Ikeja. According to di senior officer, di iron damage guy even fake im  own kidnap because he wan use format take […]

todayMay 27, 2026 7

Lagos

Lagos Police Grab 3 Suspected Armed Robbers, Recover Pistol

Lagos Police command  don robo cup style arrest three suspected armed robbers wey dey  involve for robbery wey hapun for one estate for Sangotedo on April 11 and 13, 2026. Police Tuk, tuk, SP Abimbola Adebisi, put dis for statement on Wednesday night give tori pipo According to di statement, Dem arrest dem after distress call, and police recover local pistol wey get six rounds of 9mm bullet, face mask, […]

todayApril 16, 2026 17

OBODO NAIJA

At Least 17 Kpai As Armed Men Attack Mbalom For Benue State For Easter

For Mbalom community for Gwer East, Benue State, say at least 17 pipo na im kpai after armed men attack on Sunday during Easter celebrations. Eyewitness tuk say dem fire gun wotowoto, burn houses, and force pipo run enter bush. Local resident wey nor wan give name tell newsmen say many pipo still dey miss from di race wey dem run and dat like dis dem sti dey find pipo […]

todayApril 6, 2026 19

obodo oyinbo

US Police Arrest Driver Wey kpai Nigerian Graduate Fadero

Metropolitan Nashville Police for US don arrest one driver wey dey link to fatal hit-and-run wey kpai one Nigerian graduate, Oluwalayomi Fadero. Report from local station WSMV4 say di mata na since on Friday after di suspect, Ray Eugene Padgett, thief one vehicle come dey run. Di owner of di truck trace am reach one area, but when di suspect notice say dem dey follow am, e reverse motor jam […]

todayMarch 25, 2026 15

Lagos

“25-Year-Old Man Jam Court As E Carry N7.5 Million Electric Cable For Lagos!”

One 25-year-old man, Alex Ibrahim, show for Ikeja Magistrates’ Court on Tuesday as dem arraign am for stealing electric cable wey worth N7.5 million. Alex Ibrahim wey dey live for Opic, Lagos, face charge of stealing under Section 287 of Lagos State Criminal Law, 2015. The prosecutor, SP Josephine Ikhayere, tell court say the matter happen on August 9 around 9:00pm for No. 11A Church Close, Isheri North GRA, Lagos. […]

todaySeptember 9, 2025 35

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds