By: Mariam Ajayi
US Presido Donald Trump don swear say dem go show Iran pepper if investigations confirm say dem get hand for the attack wey pilot try launch on top flydubai flight wey dey go Israel.
Di drama hapun when passengers join body help save plane make e no crash, before dem manage land for Saudi Arabia and later fly the Israeli passengers go house.
Meanwhile, UAE don open probe into the matter, and Netanyahu say the suspect don undergo Islamist radical indoctrination.
To show say im no dey play, Trump yarn say America ready to retaliate hard hard, as US military don already carry extra Patriot missile batteries go Saudi Arabia and Qatar.