By: Mariam Ajayi
US Vice President JD Vance like dis now dey dodge questions on updates of how di war between America, Israel, and Iran go end.
Tatafo pipo bin block Vance, e try to cool di matter down for White House press briefing on Thursday, con even ague say nor be war dem dey fight for Iran.
Although heavy bomb-blast don dey fly between US and Iran for days, Vance dey rake say na only Iran military weapon dem scarra.