obodo oyinbo

US Wan Rush Comot Americans From Hantavirus Ship

todayMay 9, 2026 4

Background
share close

United States don talk say dem dey arrange evacuation flight to carry Americans wey dey inside one cruise ship wey hantavirus don affect, as di ship dey head go Canary Islands.

According to one spokesperson from di U.S. State Department, government dey work to make sure say all American passengers return home safely.

Dem also talk say dem dey cooperate with government of Spain and other U.S. agencies to handle di matter well.

Di spokesperson sti add say dem don already dey communicate directly with di Americans for inside di ship and dey ready to give consular help once di ship land for Tenerife.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds