By: Jolayemi Olajide
WAEC don announce new way, wey dem wan take fight exam malpractice and make examination process faster and more transparent for candidates across obodo Naija.
Di exam body don launch one “examination malpractice quarter” for im website, where candidates wey get issues related to misconduct fit check dia status directly without delay.
Head of WAEC Nigeria National Office, Dr Amos Dangut, naim announce di update on Monday during briefing on dia ongoing 2026 Computer-Based WASSCE.
Say moving foward dem go dey release WAEC result within 45 days after the last paper, including clear updates for candidates involved in malpractice cases.