By: Esther Ayoola
Chairmo of di Chartered Institute of Taxation, Abuja District, Ben Enamudu, don clear Nigerians say, nobodi dey tax anybodi bank balances under di new tax reform.
Untop yanings with news tuk tuk pipo on Tuesday, Enamudu, say only some electronic transfers dey attract ₦50 stamp duty.
Im say, na wrong tori wey dey spread dey make people fear unnecessarily, say bank go collect tax from account balance.
Di chairmo explain oh, dat di reform dey designed to protect low-income earners, and no law dey, wey fit make gornment collect tax from money wey dey your bank account.