By : Jolayemi Olajide
FCT Minister Nyesom Wike tuk for Abuja don clear mata say e never endorse anybody for Rivers 2027 governorship election.
Wike yarn dis one for im Wednesday press brief, explaining dat e no fit support any candidate until di joint coalition of PDP and APC pipo for Rivers meet first.
E add say di coalition na political strategy to unite loyalists from both parties because dem dey prepare for future political battle.
Wike also tuk say di group no dey work with Governor Siminalayi Fubara, wey dey eye APC ticket for di election.