By: Esther Ayoola
Say Court Scarra, when One defence witness, Nnamdi Offiial, go tell Special Offences Court for Ikeja say di Economic Financial Crime Commission (EFCC) officers try force im client, Henry Omoile, make e tuk wetin nor correct against former CBN governor, Godwin Emefiele.
News Bin Report say, Emefiele and Omoile dey face charges of corruption and fraud, but both of dem don plead say dem no guilty.
Official, wey be Omoile lawyer, tuk dis one while e dey testify for trial-within-trial to check whether Omoile statement to EFCC na voluntary.
According to am, EFCC investigators promise Omoile bail and possible no prosecution if im agree give evidence against Emefiele.