Ikeja Special Offences Court on Wednesday don sentence one yahoo boy, Ndidi Joshua Bobby, giv am 42 years of jail time for yahoo yahoo wey involve fake identity and dey use lie lie to collect money.
Justice Olubunmi Abike-Fadipe na im give di judgment after court find am guilty.
Na EFCC Lagos Zonal Directorate 2, Okotie-Eboh, carry di matter go court, as dem talk say di case involve stealing and fake documents marras wey dey linked to di €80,000 scam.
Bobby first enter court for December 2021 on two charges, but later EFCC upgrade am reach six counts for July 2, 2025 under Advance Fee Fraud and other Fraud Related Offences Act 2006.