OBODO NAIJA

1,115 army officers dey sit promotion exam for rivers

todaySeptember 4, 2026

Background
share close

By: Ayobami Dada

About 1,115 Nigerian Army Warrant Officers and Master Warrant Officers don gather for Rivers State for 2026 promotion board.

Di exercise dey happun for NYSC Orientation Camp, Nonwa-Gbam, and Headquarters 6 Division na im dey host am.

Chief of Personnel Management, Major General Adewale Adekeye, advise di candidates to show professionalism and give dia best, but make dem no push beyond dia physical strength.

GOC 6 Division, Major General Everest Okoro, say di board go be fair and transparent, adding say promotion no be only about higher rank but bigger responsibility.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds