Listeners:
Top listeners:
KonfamFM 89.5 We Dey For You
General
todayAugust 22, 2025 8 3
President Bola Ahmed Tinubu don beg Nigerians wey dey abroad make dem no siddon for there, but make dem come back home because Nigeria don dey rise again under him government. Tinubu talk this one for Yokohama, Japan, during one meeting with Naija people for Tokyo International Conference on African Development (TICAD9). E talk say e happy to hear say some people don dey return back, but e still encourage others to come back so dem fit help build the country. According to am, government no fit do everything alone if Naija people for inside and outside no join hand work, development no go happen. E remind them say to be true citizen no just be to carry Naija passport, but to get correct character and commitment to the country’s progress. Tinubu also talk say government don dey make reforms like easier passport processing, stabilising economy, and better healthcare so people no go dey run abroad for medical treatment. E end by saying, “Naija don dey rise again,” and urged all Naija abroad make dem remain good ambassadors and help boost investment and growth for the country.
For the meeting, Naija community for Japan show serious support for Tinubu’s plans, with professionals, entrepreneurs, and students ready to contribute to Nigeria’s transformation. Mr. Emeka Ebogota, President of Nigerian Union in Japan, thank Tinubu for the direct engagement and promise say dem go back am well. Top government oga dem like Minister of Foreign Affairs Yusuf Tuggar, Minister of Solid Minerals Dele Alake, Minister of Regional Development Abubakar Momoh, and others dey there to back the message. With this kind support and clear vision, Naija people hope say better days dey ahead as the country dey push for more progress.
Written by: News Editor 1
Development National Presidency Rebuilding Nigeria