Listeners:
Top listeners:
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Nine more Super Eagles players don land for Uyo, Akwa Ibom State ahead of this month 2026 FIFA World Cup qualifier matches against Rwanda and South Africa. The Fulham duo Alex Iwobi and Calvin Bassey don join the camp, along with Fisayo Dele-Bashiru, Ola Aina, Bright Osayi-Samuel, Moses Simon, Chidozie Awaziem, Adebayo Adeleye, and Benjamin Fredericks.
Dem join the four players wey arrive on Monday, William Troost-Ekong, Amas Obasogie, Felix Agu, and Raphael Onyedika. Super Eagles go face Amavubi of Rwanda for Matchday 7 game inside Godswill Akpabio Stadium, Uyo, on Saturday, 6th of September. After that, dem go fly go Bloemfontein to play South Africa Bafana Bafana for Matchday 8 clash on Tuesday, 9th of September.
Written by: News Editor 1
2026 WORLD CUP QUALIFIERS Super Eagles
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025