By Ayomide Famosipe
US Presido, Donald Trump don talk say America fit destroy wetin remain for Iran, and say to build the country back go take up to 25 years.
Di Presido drop dis one for socials say very soon people go “know very soon” , dem go hear di odour across di obodo world.
Meanwhile, report talk say Iran don send nuclear proposal enter America hand through Qatar mediators to see how peace fit reign.
Washington dey look the proposal inside paper now, while Tehran dey wait make dem accept dia seven conditions before any agreement go work.