Listeners:
Top listeners:
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Lagos State Government don announce say dem go do one week repair work for Ozumba Mbadiwe Road wey start from Bonny Camp junction, from Monday 15 to Sunday 21, September, 2025.
One press release wey come from Lagos State Ministry of Transportation and wey the Commissioner for Transportation, Mr. Oluwaseun Osiyemi, sign talk say the repair work go happen for night time from 9:00 pm to 6:00 am so that e no go affect traffic too much. Dem beg motorists make dem get patience as dem dey drive through the area during the repair work.
Written by: News Editor 2
INFRASTRUCTURE Lagos NIGHT WORK OZUMBA MBADIWE ROAD REPAIR
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025