Lagos State Government don announce say dem go do one week repair work for Ozumba Mbadiwe Road wey start from Bonny Camp junction, from Monday 15 to Sunday 21, September, 2025.
One press release wey come from Lagos State Ministry of Transportation and wey the Commissioner for Transportation, Mr. Oluwaseun Osiyemi, sign talk say the repair work go happen for night time from 9:00 pm to 6:00 am so that e no go affect traffic too much. Dem beg motorists make dem get patience as dem dey drive through the area during the repair work.