Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Di Enugu State Police Command don confirm say dem don arraign one woman wey accuse her husband of defiling and raping dia two daughters. SP Daniel Ndukwe, di state Police Public Relations Officer, talk say di woman, Mrs Chisom Okonkwo, report di matter to police but she no fit prove di allegations well well. During investigation, di couple elderly child give written statement plus video evidence say di papa no do di thing wey dem dey accuse am of, and say di mama don teach dem lie against di papa. Police talk say on October 25, 2025, dem receive complaint from Chisom (29) for Emene Police Division say her husband, Okonkwo Ozioma, dey defile dia two daughters aged five and three, and threaten kill her if she talk.
Investigation show say di allegation na lie and misleading. Police find out say di periods wey Chisom claim di offences happen for 2024 and 2025 na di same time wey she travel alone with all di children go dia hometown for Imo State. E still show say for two separate handwritten voluntary statements, dia seven-year-old son clear dia papa and yarn say dia mama teach am and dia sisters to falsely accuse dia papa, wey video evidence support. Okonkwo don arraign for Enugu Magistrate Court for two-count charge of defamation and giving false information, court grant her bail, case adjourned for further hearing. CP Mamman Bitrus Giwa hail detectives for fair and thorough investigation, warn say anybody wey dey give false or malicious allegation go face law.
Written by: News Editor 1
Enugu news 2025 Enugu woman arrested Husband defile children accusation
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025