Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
By: Rilwan Agbomeji
Di Lagos State Wastewater Management Office don seal Yakoyo Abula Joint Restaurant for Victoria Island because dem dey pour untreated wastewater and oil inside public drainage. Commissioner for Environment and Water Resources, Tokunbo Wahab, reveal di action for im X handle.
Dem shut down di restaurant on Tuesday morning afta officials see say dem dey deliberately discharge dirty water wey don block drainage and fit cause waterborne diseases.
Written by: News Editor 1
Lagos environmental enforcement Yakoyo Abula Joint sealed
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025