Lagos

Lagos Gornment Cut Chain For NEPA To Solve Light Palava

todayNovember 6, 2026 4

Background
share close

Based on di worwor character of NEPA pipo for inside Lagos.

Lagos State Gornment don put mouth say make NEPA pipo con see dem for November 10 to 12, 2026 inside one big energy summit to solve di continuous light palava.

Na senior man Commissioner for Energy and Mineral Resources, Biodun Ogunleye, porporly dis mata, say weda na electricity regulators, DisCos, and suppliers, say make dem con explain why Lagos nor fit get 24 hours light.

Inside dis meeting dem go fix heavy issues like bad regulation, poor distribution, meter matas, and how dem go take use alternative energy.

Oga Permanent Secretary, Ibilola Kasumu, scarra everywia say di summit no go be just long tok, but experts go sit down face these specific problems directly to bring real solution.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds