By: Rilwan Agbomeji
Now make we comot body enter court, wia wi Former Labour Minister, Chris Ngige, deny all di 8 charges wey EFCC put for im head, for Abuja High Court and dat im carry ₦2.2 billion contract give family and friends.
Di Minister say walahi im nor do anything like dat.
Justice Maryam Hassan talk say make Ngige rent one room for Kuje Correctional Centre since im dey deny, and dat dem go get im time on Monday, December 15, 2025.
On top yarns with tori pipo afta di court Ngige Lawyer, na carry di mata for head unto wetin play for inside di courtroom.