Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
By: Rilwan Agbomeji
Lagos State Govment don sound alarm for drivers and commuters say make dem plan dia movement well well as some big roads for Lagos island go lock on Saturday sake of Eyo festival.
Major routes wey go feel am include Third Mainland Bridge, Obalende and oda nearby streets around di Island.
Government talk say di diversion na for small time, so as to make di colourful Eyo Festival run smooth without traffic wahala.
Di traffic advisory drop Wednesday through Lagos State official X page, as authorities beg road users make dem follow instructions and use alternative routes to avoid gbege.
Written by: News Editor 1
Lagos commuters alert Lagos road diversion Saturday Obalende road diversion Obalende traffic update Third Mainland Bridge traffic
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025