Uncategorized

No Big State Fiesta, No Wahala: Lagos Celebrate New Year Wella

todayJanuary 1, 2026 8

Background
share close

By Ebi Oboko

New year 2026 celebration for lagos nor be here oh, Oga govo, Sanwo Olu leading the way, say make everybody quietly enter dia church pray for peace, progress, good governance and security. Say make lagosians pray for lagos state beta style.

As a result, Lagos no hold di normal Greater Lagos Fiesta for December 2025, but people still knack small parties, beach DJ marathon, and cultural shows.

Police deploy plenty officers make sure say everybody dey safe and warn against big fireworks.

Di 2025 Eyo Festival come back, wey Governor Sanwo-Olu host to honor Lagos legends like Lateef Jakande and Mobolaji Johnson.

According to the lagos gorment, Lagos dey celebrate New Year 2026 sha, moving from Detty December to Afro-Brazilian Fanti/Caretta Carnival, security and culture still dey top priority.

Written by: News Editor 1

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app