By Ebi Oboko
Lagos State All Progressives Congress, APC, tuk tuk, Hon. Seye Oladejo, don tuk again oh, say the party dey fully support oga Presido, Bola Tinubu New Year message and reforms.
According to Oladejo, through one official statement, say because dem believe say Tinubu dey take hard but necessary decisions to fix Nigeria, dem go support am beta style.
Oladejo say for Lagos, APC see signs dat economy dey stabilize, investors dey come back, and government projects dey move despite opposition noise.
E add say Lagos dey support the President because reform na how progress take dey come, even though if e require patience and sacrifice.