By Ebi Oboko
Ogun State Police don confamate say dem don arrest the driver of the Lexus SUV wey get accident wey kill di two frens of former boxing champion Anthony Joshua.
The accident happen on Monday for Lagos-Ibadan Expressway as the vehicle jam stationary truck, kill Latif Ayodele and Sina Ghami on the spot, while Joshua and the driver get minor injuries.
Police PRO Oluseyi Babaseyi talk say investigation dey go on to know wetin cause the crash and the role of the driver.
Ogun State Governor, Dapo Abiodun, also confirm say Anthony Joshua don discharge from hospital and dey recover well for house.