By Ebi Oboko
Oga Govo of Lagos, Babajide Sanwo-Olu, omo enter area, don ginger aproko pipo wey be say dia work na to tell story about Lagos, say, make dem no give up, say make dem continue and to also joinbodi with goment to grow the creative economy.
The govo dey tuk Dis one on Tuesday for Lens for Good 2026 Storytellers’ Conference wey carry di theme “Stories dat Move Us,” wey hold for Wole Soyinka Centre, Iganmu, Lagos.
Sanwo-Olu press tuks say Lagos na city wey get vibes, owambe and jolliment choke beta style.