By: Esther Ayoola
Lagos State Govo, Babajide Sanwo-Olu, say, belle nor sweet am dat some residents dey risk dia lives unnecessarily, go scrap fuel, for road because say tanker fall for Liverpool Bridge, Apapa, say, dat kin of doings, nor make brain at all, at all.
Di govo tuk with tori pipo for di state capital yesterday dat, gorment no dey play with safety of Lagosians life.
E praise di police and other first responders wey quickly secure di area, and warn residents, make dem no ever try such dangerous act again.