Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
By: Esther Ayoola
Lagos State Gornment don warn residents make dem stop using unsafe water, say e dey dangerous to health and environment.
Executive Secretary of Lagos State Water Regulatory Commission, Oluwabukola Adeyemo, tuk dis one for one community meeting with water stakeholders for Epe.
She say many water wey Lagos get no dey drinkable, unless dem treat am wella because of salt, dirty substances and heavy metals.
Adeyemo warn say anyhow borehole drilling and poor hygiene fit cause serious waterborne sickness for di state.
Written by: News Author
Drinking Water Advisory Lagos Water Quality Lagos Water Safety Public Health Alert Lagos
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025