By: Esther Ayoola
Di Economic Finance Crime Commission on Thursday don reveal new kpiance doings of yahoo and fake air ticket discount wey don rip hundreds of Nigerians dia billions of naira.
According to report, One group dey run fake Airline Discount Scheme (ADS) to trap people, while another company, wey dem dey call, Fred & Farid Investment (F&F Investment), dey use fake investment plan take collobi naija pipo money.
EFCC Public Affairs Director, Wilson Uwujaren, ni konfamate all dis during press briefing for Abuja.