By: Esther Ayoola
Oyo State Govo, Seyi Makinde, don declare say di pipos democratic Party nor get any problem, say pipo wey im dey call “vagabonds” don comot for di parti
Makinde yarn dis one on Tuesday for Ibadan during unveiling of Oyo State PDP secretariat.
Di Oyo state govo dey tuk dis tuk, afta former Rivers State govo, Nyesom Wike, on Monday for PDP NEC meeting for Abuja vow say e go protect party from internal “vampires” and saying dat Ibadan don collapse.
Makinde say PDP for Oyo don clear kontri mehn before say, PDP don suspend all di mehn wey dey scata dia parti, say im nor understand why pipo sti dey listen to pipo wey dem don suspend.