By: Esther Ayoola
Anthony Joshua promoter, Eddie Hearn, don drop bumbshell, say e no sure whether Joshua go fight again after im lose two close padi for car crash for Naija.
Joshua don dey try enter gym small, but e never sti do any proper training for boxing.
U sabi say, afta e knock Jake Paul finish, Joshua travel come visit family, but wahala sup, when im car get askident,  kill two of im closest padi mehn, Sina Ghami and Latif ‘Latz’ Ayodele.
And based on dis, Joshua March fight and possible fight with Tyson Fury dey uncertain now.