By: Esther Ayoola
Say nor small go slow for Lagos, dat Truck drivers, members of di Nigerian Union of Haulage Truck and Trailer Drivers, on Monday protest say dem nor go gree, task collectors wan kpai dem with tax.
Dem say Lagos State Taskforce, Vehicle Inspection Office, and LASTMA dey harass, beat, and extort dem under guise of enforcement.
Dis protest sef sup afta one driver, Comrade Prince Ogunkanmi Adekunle, nearly Kpai during night operation for Ikeja on Saturday.
National Chairmo, Okunola Omogbolahan, sha explain give newsmen on Monday say, dia protest na to stop brutality and call for gornment help.