Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
By: Esther Ayoola
Lagos State Emergency Management Agency (LASEMA) like dis now, dey vex oh, dey, warn drivers to stop wawawa driving asap, afta two pipo kpai for askident wey hapun Thursday morning for Cele Bus Stop, Apapa-Oshodi Expressway.
Untop yarnings with tori pipo, LASEMA Permanent Secretary, Dr Olufemi Oke-Osanyintolu, say, di two 40-foot container trucks wey nor get plate number, collide, jam di other one wey park on im own.
Oga Olufemi say, na beg im take dey beg driver, make dem take am easy as life nor get duplicate.
Written by: News Author
Lagos road crash Lagos State Emergency Management Agency Lagos Truck Accident Two Dead in Lagos Accident
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2026