By: Esther Ayoola
Baba govo of Oyo State, Seyi Makinde don share update say, na sabi man and loyalty to Oyo State go decide who go succeed am as govo for di 2027 elections, and by loyalty to im di governor.
Di Govo make di statement for inside di 12th Omituntun Annual Ramadan Public Lecture wey shelle for Ibadan.
Makinde yan plenty, show report card, say im gornment don pay over ₦25 billion, clear old gratuities and increase monthly payment from ₦1 billion to ₦3 billion so dat by May 2027 no retiree go suffer.
E sti mention say dem dey upgrade Samuel Ladoke Akintola Airport to international level and express hope say by May 2026, e go start work.