Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Two people don go kpai for one serious askident wey happen on Wednesday for Beere Roundabout inside Ibadan, Oyo State capital.
Police tuk, tuk, Ayanlade Olayinka, na im dey konfamte dis mata give tori pipo, say one man and one woman die immediately when one Mack truck wey belong to oil and gas company lose control as e dey come down from Beere area.
According to am, di truck lose brake, na im e run enter some vehicles for busy Oje fruit market axis.
E still add say two other people get different kind of wunjuries as result of di crash.
Written by: Ridwan Agbomeji
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2026