Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Say Nigeria go play Portugal and Poland for big international friendly games for June.
Super Eagles, wey just beat Iran 2-1 and draw 2-2 with Jordan for Antalya, Turkey, don dey ready for dis summer programme against European teams.
Dem go face Poland for PGE Narodowy Stadium, Warsaw on June 3, before waka go Portugal for second friendly on June 10.
Portugal don also konfam say Nigeria go be dia last opponents before dem enter di 2026 FIFA World Cup for North America.
Written by: Ridwan Agbomeji
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2026