US Presido, Donald Trump, like dis now dey threaten say e go fit destroy Iran power plants and bridge if dem no open Strait of Hormuz by Tuesday.
Im tuk dis one for im truth socials, dat if Iran nor behave demselves e fit release “hell”, but believe say deal fit hapun with Tehran.
Iran on dia own part dey laugh Trump threat, dem call am “helpless, nervous and stupid.”
Dis one dey come after Trump give update dat, second US fighter jet crew member wey Iran bin capture don regain freedom.