By: Esther Ayoola
Lagos State Emergency Management Agency (LASEMA) don warn residents make dem dey careful with electrical things and report any emergency through di toll-free lines.
Di warning follow two fire wahala wey hapun for different parts of Lagos on Sunday because of electrical surges.
Head of Public Affairs, Afolabi Olawale, naim dey Konfam say, one fire happen for FESTAC Town Phase 2, where single-storey building catch fire afta conduct wire spark.
E tuk say quick action by LASEMA Response Team and Lagos State Fire Service naim hellep to stop di fire from spreading to di top floor and nearby buildings.