Arne Slot say Liverpool believe say dem fit do “special things” when dem host Paris Saint-Germain for Anfield for Champions League quarter-final second leg on Tuesday night.
Goals from Desire Doue and Khvicha Kvaratskhelia give PSG 2-0 win for first leg wey dem play for Parc des Princes on April 8, but the Dutch coach say di work wey dey front no be mai mai.
Liverpool need 3 goals to win if PSG no score at all, but if PSG Score like dis, kasala go dey.