Lagos

How Lagos Govo Dey Ginger Mehn To Give Youths, Leadership Position

todayApril 15, 2026 3

Background
share close

By: Esther Ayoola

Oga Govo of Lagos State, Babajide Sanwo-Olu don declare say make leaders dey try carry youths along, as e dey important for national development.

E tuk dis one for Abuja Dialogue 2026 wey dem hold for State House Banquet Hall, Abuja.

Di programme na di Office of Vice President and Lateef Jakande Leadership Academy organise am, with theme wey tuk say youth leadership na important structure for development.

Sanwo-Olu sti add say di question nor be whether youths fit lead, but whether beta system dey wey go guide and support dem to perform.

Written by: News Author

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app