By Ebi Oboko
Speaker of Lagos State House of Assembly, Mudashiru Obasa, don drop yarns, say Lagos go continue to push Nigeria economy forward, even though Abuja naim be di Federal Capital Territory.
E yarn dis one when e receive new leaders of Lagos Chamber of Commerce and Industry wey Leye Kupoluyi lead come pay am courtesy visit for Assembly.
Obasa explain how Lagos still tey be di best place for pipo wey wan invest for Nigeria, because of beta laws like PPP law, Employment Trust Fund and Lagos Lottery Law.
E add say all these laws dey help entrepreneurs, attract investors, and make Lagos remain Nigeria business centre.