By: Esther Ayoola
US Presido, Donald Trump don tuk say dem nor go lift di blockade wey dem put for Iran ports until dem reach agreement with Tehran.
Di US presido Tuk for im Truth social say di blockade don dey affect Iran badly and say US dey win di for now.
Say like dis, di temporary ceasefire between US and Iran go end on Wednesday, but nobody sure if new peace tuk go sti hapun for Pakistan or not.
Normally say US Vice President JD Vance wey suppose lead di peace tuk never even comot from Washington yet, while Iran still dey consider if dem go show.