Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
By: Esther Ayoola
Lagos State Attorney-General, Lawal Pedro, don explain why Lagos gorment free di suspects wey bin dey dia net for di killing of six traders for Owode Onirin, dat gornment no dey hide anybody wey dey involve.
E say decision not to charge di suspects na because akelebe investigation no show clear evidence wey link them to di crime.
According to am, di black uniform men, wey we sabi as police send di case file give Ministry of Justice afta dia initial findings, as law require.
Afta checking di witness and di suspects statements, di gornment con conclude say no strong case, so dere was no need to keep dem.
Written by: News Author
criminal case Lagos Lagos Attorney General Lagos State judiciary Owode killings suspects discharged Nigeria
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2026